you have the possibility to publish an article related to the theme of this page, and / or to this region:
Ireland - -An information and promotions platform.
Links the content with your website for free.
Ireland - Web content about Nigeria vs South Africa
Di Super Eagles of Nigeria bin fail to beat di Bafana Bafana of South Africa for di 2026 Fifa World Cup Qualifier wey happun for Uyo.
Dis na di third unbeaten for South Africa as Nigeria fail to beat dem again for home soil, Uyo, di Akwa Ibom State capital.
Afta a fruitless 28 minutes of play between di two teams, Zwane put di ball in play wit a beautiful strike wey drop for di back of Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali.
Di scoreline change as South Africa take di lead wit a one goal difference as Super Eagles dey struggle for a goal.
Ademola Lookman and Alex Iwobi play togeda to try find di back of di net for first half but dem no fit and South Africa goalkeeper Williams dey kampe.
Surprisingly, few seconds into di second half, di Super Eagles equalise wit a beautiful strike from Fisayo Dele-Bashiru afta di correct assist from Alex Iwobi.
“We bin think about to bring am in, e suppose to come in, but wen we hear Ajayi complain say im no fit kontinu we gatz change our plan” Finidi tok for im post-match conference.
Currently, Lesotho dey lead di Group C wit Rwanda for second position.
Nigeria dey 5th position but dem go face Benin for dia next game while South Africa wey dey 4th position go face Zimbabwe wey dey bottom of di group.
90+4 mins - Mudau trying to create chance for South Africa.
Lookman move wit di ball again, finding whom to pass give.
90+1 mins - Stanley Nwabali dey post to catch di ball.
Lookman take di ball, swing into di side, hit wit a shot - but di goalkeeper push am.
Di crowd dey cheer di players.
Lookman take di ball, move it closer, hit di ball but Misbau block am.
83 mins - Bassey win di ball, put it in play for Nwabali wey later launch am out.
Some South Africa players dey tire.
Mvala dey gas out for di pitch and di play dey on by Lookman but blocked by Ngezana and Mudau.
Corner taken by Lookman very fast.
Nigeria building pressure.
For Nigeria.
Chukwueze collect pass from Iwobi, move to di post to collect di ball back as im tip am for di top of South Africa goalkeeper but e hit di bar and bounce back.
What an incredible for Tau, Oh no, ova di bar.
Im get free space to move and shoot inside Nigerian net.
Iwobi wit di ball, move a bit, thinking of wetin to do wit di ball, oh no, indecision make Bafana Bafana attack di ball comot from im hand.
Chukwueze play correct ball, give pass to Yusuff but e lose am, but still wit Nigeria.
Chukwueze working so hard to get di ball back.
Ndidi find Lookman for di 18 yard but e no convert am.
Tau dey try break Nigeria midfield but Bassey and Iwobi dey stop am.
Lookman take di corner, Bassey try struggle for di ball, but e no dey enough.
Nice counterattack by Zwane but im no fit complete am.
Correct ball from Iwobi.
Osayi-Samuel wit di ball, e find Lookman, Lookman find Osayi-Samuel again.
Ball go to corner for Nigeria.
Correct run by Dele-Bashiru into di box 18, im fall for box 18 but referee no blow.
Ball in possession.
Iwobi dey do great assist for di Super Eagles.
Amazing start for di second half.
23 yrs old Dele-Bashiru don make di score equal.
Nice crossing from Lookman to Onuachu wey give am correct header oh, but di header no too strong as e land for Williams front - e catch am.
Foul, dem fall Lookman down.
Nice pass between Iwobi and Lookman, but im no fo well.
Good shot by Ndidi for Nigeria.
Jersey Number 17 for South Africa almost put anoda goal for post oooooo.
Wetin Nigeria defenders dey do like dis.
Mokoena and Sithole dey try create chances for South Africa but Iwobi stand gidigba to dey clear anytin comot for dia legs to Nigeria.
To be taken by Iheanacho.
But im play am wide bifor Bassey go fit reach touch am for back of net.
Oh, what a nice crossing from Ndidi, but na straight into di hands of Williams South Africa goalkeeper.
Ademola Lookman, di Atalanta star dey give some correct dribles but di ball don go goal kick bifor im pass am.
Lookman take di free kick, put am for middle but no Super Eagles player dey to shoot am inside post.
Jersey number 11 play di free kick for South Africa but na ova di bar as Nwabali no even too stress imself to fly.
Nigeria dey put ball in possession as Bassey dey hold di back well.
Ajayi no gree for South African players.
Nwabali dey confident for post.
Nwabali, Ajayi, Bassey, Tanimu, Osayi-Samuel, Dele-Bashiru, Iwobi, Ndidi (C), Iheanacho, Lookman, Onuachu.